Covenant University, don suspend 200 student, for sey dem no attend the school Easter program.



Dem don suspend 200 students wey dey the Covenant University, Ota, Ogun state, for say dem no attend the  Easter “Youth Alive” programme wey shelle inside the school.


As the matter be, student and Parents, don dey para, dey yarn their mind ontop the matter, sey this matter no mek sense at all.
Dem yarn sey their admission no show sey, e dey compulsory for dem to attend the Easter program.

The mama of one of the final year students yarn say, this thing wey the school do, no mek sense, as no be by force to go Easter program.

Read wetin one 400-level student yarn ontop the matter.

“We were going for the services in the morning and night and people were getting tired of it because we were also preparing for exams. So, the Vice-Chancellor got angry and ordered that those who missed the services be sanctioned“Some were suspended for four weeks and those who had missed eight services for the four days got a year.”.

Read wetin this 300-level student, yarn ontop the matter,

 “The mood in school is really tense. Though students are not protesting but they are angry because you are preparing for an exam you’re not sure you will sit for, until the paper starts.


“They stopped me from sitting for a paper last week because I did not go for a service and I don’t know if I will be allowed in today either.”

Previous
Next Post »

Featured Video