“Fuck You, You’re An Idiot, Dirty Looking Igbo Smoker” – Timaya blast Eedris from left to center Ontop Instagram.



The Agberipapa 1 of Bayelsa Timaya, don para enter IG, con give rapper Eedris Abdulkareem better lamba after Eedris callam ''ingrate'' for one interview.

Image result wey dey for idris and timaya

Timaya wey enter im Instagram page, blast craze comot from the rapper head after the rapper say, Timaya no fit thank person after im helpam. Eedris yarn this one for one interview with GoldMyne TV.

Eedris yarn say, Timaya for no makam if no be for the advice, and gingerness, wey im put for Timaya body, the rapper still yarn say, no need for Timaya to thank am cause na God nayim im do am for.

As the matter be, Timaya enter im IG page, con share one video, where im for blast the rapper from left to center, coallam idiot and dirty Igbo smoker.

See vidio below



Previous
Next Post »

Featured Video