Vice presido, Yemi Osinbajo don beg NASS say mek dem approve $1.49bn loan for 10 states inside Naija.



Vice Presido, Yemi Osinbajo don write letter give the National Assembly, dey tell dem say, may dem approve the loan wey reach about $1.49 billion to ten states inside Naija, for beta projects.


The senate Presido Bukola Saraki and Speaker of the House of Representatives nayim read the letter for on Tuesday meeting.

The ten states wey dey ask for the loan na Ogun, Ebonyi, Kaduna, Kano, Abia, Katsina, Jigawa, Enugu, Plateau and Ondo states.

The state governors, for the states don yarn say, dem go use the loan take produce water, beta health , agriculture and to build beta things inside the state.

Osinbajo letter yarn say, dem won collect the money from the African Development Bank, French Development Agency, World Bank and slamic Development Bank, and these banks, no go charge dem high interest rate.
So may the Senate dem, sign the paper so the ten state go fit get money from outside Naija, so dem go fit handle their mek sense projects.





Previous
Next Post »

Featured Video