Presido Buhari yarn say, im no go chuck mouth ontop senate wey reject Ibarhim Magu, until senate send am official letter, ontop the matter.



The senate don been reject Ibrahim Magu, for december, dey con still reject am this second time. so this na the second  time wey dem dey reject Magu.

Buhari has not been official briefed about the rejection of Magu by the Senate

Ibrahim Magu, wey the Senate, screen yesterday Wednesday, March 15. but things no go well, as DSS, koba Ibrahim Magu, say im fail one security test, wey dem give am, as dem send letter give senate, when Magu don dey finish screening with dem.

The Senate don yarn say, Magu, no fit be the acting oga kpatakpata of EFCC again, say mek Presido Buhari, choose another person for the position.

Presidency don yarn ontop the matter wey concern the Senate, after dem reject Ibrahim Magu, as the oga kpatakpata of EFFC, say mek senate write letter, con give President Muhammadu Buhari ontop the matter, before presido, go chuck mouth inside.

Femi Adesina, wey be the special adviser to presido, ontop media and publicity matter, tweet for twitter say, President Buhari, no go chuck mouth inside the matter, on till Senate, sends am official letter.

See the below..




Previous
Next Post »

Featured Video