Federal Government, don yarn say, Friday April 14th and Monday April 17th, go be public holiday.
This na to mark Good Friday and Easter jollification, wey go shelle for April 14th and Monday April 17th
Minister ontop Interior matter, wey be Abdulrahman Dambazau, announce this one, for one statement, wey dem release today.
Dambazau, yarn say mek christian, inside Naija follow wetin Easter stand for, wey be love, peace, justice, sacrifice and kindness, as dem dey live their life.
ConversionConversion EmoticonEmoticon