About 40,000 French people don come out dey shout say, dem want mek Barack Obama, be their Presido.



Some French Citizens, don come out dey yarn say dey wan hire Barack Obama to be the president of France.  


About 40,000 France people, don support One campaign, wey dey shelle inside France, as dem want mek Ex US Presido Barack Obama, be their Presido, as dem sign one order, say mek im run for French presidential office.

As he be, the people wey dey organize this campaign, wey dem call Obama17, don spread poster for every where, inside Paris.
Dem con still put one slogan wey be "Oui on peut" wey mean "Yes we can "

The people, wey dey organize this one, yarn say, dem wan get like many million people, wey go sign this one, before, May 15th.

Read wetin dem yarn..

“The French are ready to make radical choices - that is good because we have a radical idea to propose to them,”. 
''To launch this 6th Republic, we wish to strike a blow by electing a foreign President as the leader of our beautiful country. 
“Barack Obama has completed his second term as President of the United States on 21 January, why not hire him as the President for France?”

Marine Le Pen, Emmanuel Macron, François Fillon, Benoît Hamon, Jean-Luc Mélenchon. na people, wey dey contest for the seat of Presido inside France.

We hear say, some of this men wey dey contest, get bad things, wey dem don do before, nayim make dem, wan mek another person, from another country, run as Presido.



Previous
Next Post »

Featured Video