Yes another tori don land o, and the yarn be say, phone dey cause cancer of the brain, and na radiation, as oyibo take put am, wey dey comot from phone, nayim dey cause cancer of the brain.
To run from this cancer, you go need to reduce the way, wey you dey take use your phone.
This one no mean say, you no go use your phone again o, watin e mean be say, you go dey use scope take dey use your phone.
We don fine many ways, on how you fit take use your phone, so cancer, no go affect you.
As per the cancer wahala, all wetin you need do, na to follow all the ways, wey we won sama you with, you go see am say, cancer go carry race, run from your matta.
A. Dey use headset or loudspeaker:
E be like joke to you, loudspeaker dey reduce radiation like mad, as e no go make you, put your phone near your ear, or body, sake of say, as your body far from your phone, na so radiation go take far from you, and as e dey hot, na so cancer for brain, go take far join.
B. If you fit, Use text message well well:
So we dey advice make you use text massage always.
C. No use your phone mek call when the bar low:
This one nayim worst pass o, if your phone bar or signal no plenty abeg rest, no call again, until your phone bar don full, , sake of say, as the bar small, and you dey try use am like that, take make call, many radiation nayim go come out from your phone, and so therefore, you dey use your hand take dey call cancer for brain.
Shey you know say, lift, and motor, get metal inside them, and this metal dey carry radiation, you come dey make call inside, join the radiation, wey your own phone dey bring.
he no good at all for your body. see eh, radiation plus radiation, equator risk ontop brain to cancer.
ConversionConversion EmoticonEmoticon