Check out this 3 tips wey go hellep you comot depression and Anxiety from your life.



We believe say this 3 Life tips, go help you solve that depression matter, wey dey bring you down.

Image result wey dey for depression and anxiety

Depression and anxiety na one big wahala, for many people life. and one thing be say, this depression matter, don enter their blood.

To get beta life, you need to follow this 3 Life tips, as we don see many people, wey don use am, con see say, their life beta.

One thing, wey mek this 3 tips make sense, na be say, he no dey hard at all, he dey very easy to do, he no get any side effect, and this tips, no go, affect the way you dey feel, e.i your ''Emotion".


Oya see the tips below:

1.Dey Do Beta Exercise..

Exercise dey very good o, as he go mek you, no dey too carry face down wey be depression, or dey fear about wetin go shelle tomorrow, wey oyibo dey call anxiety.

Exercise, dey help you stress yourself, as this stress, go help reduce your stress hormone, wey dey inside your body. and one thing be say, as person stress hormone dey reduce, the person body go dey kul, as im go get peace and happiness inside im body.

But, mek sure say, the exercise, wey you dey do, no too much for your body. do wetin your body fit carry.

Image result wey dey for exercise

2. No Dey Eat ‘Bad Food’

The food wey you dey eat, fit affect the hormone, neurotransmitters and nervous system, wey dey your body.

This 3 big oyibo grammar (hormone, neurotransmitters and nervous system) nayim i dey call power 3, as dem dey help you balance your body wella, but he depend on the kind food wey you dey eat.

No dey eat bad food, cause this bad food, fit stop your power 3, as your body system, no go balance wella.
food wey dey nylon, fit affect our power 3, as he go mek our system no work as he suppose to.

Image result wey dey for nylon bad food

3. Do Something Wey Go Mek You Happy Everyday.

This last tip, na to do something, wey dey mek you happy, and write those things down.
write things wey you dey do everyday.

If you do all this tips, wey we don yarn so, we believe say your depression go, go down shapaly shapaly, and every thing go mek sense again.



Previous
Next Post »

Featured Video