Some people don forget the correct work wey water dey do for their body, oya check mek you see the betaness of water, for you life.



Water na one ogbonge thing wey everybody need, but we don observe say, some people no dey too take this water, as dem suppose take am.


Image result wey dey for water

One beta thing about water, na be say, e go mek all your body system, dey work wella, and mek you gallant.

As the matter be, your body carry 60 percent of water, and na this water, dey mek your blood cell, organ and even your tissue, work wella, as e dey  control and maintain your body temperature.

If you dey breathe, sweat, or as  you dey hammer confirm food, na water dey commot from your body, and as water dey commot from your body, you go need to drink many water, to take replace all the one, wey don waka commot, from your body.

But one thing be say, you need to maintain how you dey take this water, because some place wey get hot weather condition, fit take in many water as dem like, unlike places wey their weather condition, dey very cold.

Water dey help you, commot all those yamayama wey dem dey call waste, from your body, e dey make your body system dey function  ghidigba, e go even make  mighty shit, turn soft, so your ynash, no go tear.

If you take water well well, you no go faint, you no go loss many water from your body, and your life go move wella, without plenty plenty wahala.

Previous
Next Post »

Featured Video