Woman die with her Two children inside serious Fire Gbege



Woman die along die as she won save her chlidren from serious Fire gbege

One 42-year-old Mama wey name na Mrs Blessing Arigi-Osakwe, loss her children for fire gbege con later die on Sunday when she try to save dem as she injure wella ontop the matter.
This fire gbege shele for on Saturday for their house along Trade Fair, Old Airport area for Sokoto.
She die on Sunday due to say she get many injury wen she go try to save the children. 
One witness say the woman, her husband with her other two older children don escape the fire. but she con later run go enter the fire to save the younger once. one of the children na her Nine years old son and nephew.
The witness still say the roof wey dey burn fall ontop the woman body as she try to save the children
Dey say wetin cause  this fire na one electrical fault wey happon inside the house, wen dem dey on their generator.
Dey don carry the dead bodies dem go put for morgue for inside Usman Danfodiyo University Teaching Hospital, Sokoto, the other older children dey receive treatment.



Previous
Next Post »

Featured Video