Omo Our Boys nack Denmark 2 okolo we go enter desame trouser with Germany for semifinal.Rio 2016



Omo Our Boys nack Denmark 2 okolo we and Germany go enter desame trouser.





Niaja Under 23 team for the Rio 2016 Olympics don enter Semi-finals , so we fit win medal as we nack Denmark 2-0.

John Mikel Oni wey be the captain show us say yes nayim be the real captain. as im score the first go for the  16th minute wen Imor Ezekiel pass the ball givam.
 he never finish o Amuzie shut better shot he con go enter corner kick, Mikel Obi play the corner nayim Aminu Umar nackam enter post for the 59th minute.

Denmark say dem must score o but our keeper Emmanuel Daniel say no, never. 

Upon all the things wey Denmark do, score dey no fit score, as our boys mek sure say dem no pass dem.
Samson Siasia just dey happy anyhow, cause we don enter Semi Final. Nigeria go play Germany for the semi final for Rio 2016


.


Previous
Next Post »

Featured Video