He be like say Tonto Dikeh marriage with Churchill don turn upside down.



Aproko just dey fly up and down for internet say, Tonto Dikeh marriage with Churchill, don turn upside down.



Her 17 months marriage to her man, Oladunni Churchill, nayim internet carry say wahala don enter inside.

As the matter be, aproko for today still say, he be like say another woman dey involve, but people no too reason the matter, on till Tonto Dikeh comot her husband name Churchill from her Instagram handle.
This one nayim mek people dey think say, he be like say, dey are up to something.


But one source yan say, na wa o, nothing dey shelle, the hubby and wife no get any wahala, dem dey fine wella, say, mek dem forget say she change her name for IG.

Another source say, dem been get small wahala, but the wahala na small thing sha.

Previous
Next Post »

Featured Video