Lionel Messi and Cristiano Ronaldo with Antoine Griecmann go chuck leg for the same trouser to win the 2016 FIFA best player award.



Lionel Mercy and Cristiano Ronaldo don win the last eight world best player award. this particular one, go shelle for on  January 9 inside  Zurich, Switzerland 

Griezmann joins Ronaldo & Messi in battle to be The Best

Lionel Messi and Cristiano Ronaldo with Antoine Griecmann go chuck leg for the same trouser to win the 2016 FIFA best player award.

Lionel Messi, wey don win this Award Five times, and don do wella as Barcelona win the 2015-2016 La Liga title, but con miss one penalty as Argentina loss the 2016 Copa American Final to Chile 2-4 for penalty inside MetLife stadium for east Rutherford, New Jersey.

C. Ronaldo self na Baba on im own, as im don score 51 goals for the 2015/2016 season. C. Ronaldo don even win the UEFA champions League With Real Madrid, and the  European Championship with Portugal.

for Antoine Griecmann part eh, the guy don finish as Euro 2016 top scorer for the 2016 FIFA Best player award

Na FIFA dey organize this award as dem don end one six year paddy paddy waka with the French magazine  France Football for the FIFA Ballon d’Or award.

Previous
Next Post »

Featured Video