#ElClassico Madrid lead Barca after Madrid play 1-1 with Barca for camp Nou



Bercelona don nearly win Real Madrid for El Classico this Saturday evening but nearly dey say, no fit kill bird.


As nearly no fit kill bird, Real Madrid captain Sergio Ramos nack the ball enter net for the last minute for normal time, as this goal go mek sure say Madrid title no loss as dey carry 1-1 draw against Barcelona for Camp Nou.

As he be Barca wey no dey do well for La liga this season, score their goal after the half time break, but no later get wetin dey want as Madrid score for the dying minute.
Ramos nack the ball enter net with Modric free kick wey be say Arda Turan foul cause ontop Marcelo

Joy nayim full Zinedine Zidane boys face with C Ronaldo wey loss plenty chance to score goal.

Now Madrid dey lead Barca with six6 point ontop the la liga table.



Previous
Next Post »

Featured Video