The house of Representatives don order all law enforcement agencies to start to arrest does people wey dey promote the Ponzi scheme MMM.
The lower house for on Wednesday, the 9th of November, don agree say MMM go bring trouble inside Nigeria, so mek dem stop am now.
Dey still yarn say, anybody wey dey fine dey promote MMM, say dem go treats that person like Criminal and security agencies go arrest that person.
Read also; CBN don warn Nigerians about MMM say na fraud and mek dey comemot hand from inside.
Akinlade Fijabi wey come from Oyo state nayim raise the motion, while the legislators for the house con move the motion.
Akinlade Fijabi describe this MMM scheme as 'Rob Peter To Pay Paul Scheme'
im still yarn say MMM dey use the situation wey Nigeria dey as people dey desperate to make money through any means.
The legislators for the house yarn say this one na matter wey be say concern the whole Nigerians, after dey hear say, some members of MMM dey organize seminar to train people, ontop how dey go fit invest inside the business.
ConversionConversion EmoticonEmoticon