Gov. Ayo Fayose of Ekiti on Sunday don tell Oke-Ako say make dey calm themself say security agents dem go try to fish the person wen kill two peoson for the community on Friday.
Na the governor’ Special Assistant for Public Communication matter Mr Lere Olayinka .na him read this one
The thing wen dey write for the book condem the gbege wen the herdsmen for Oke Ako town for Ikole Local Government Area of the State do.
``Fayose con speak one big grammar say na the height of callousness wen this people do.
``Him con worn dem seriously say make dey no try that kind bad crime again, say dey no go fit guarantee whether dey go gbege dem back dey if dey repeat am.’’
Him con still say those bad belle and devil agent say dey go fine dem enter cupboard as the matter dey go...
Oya read wetin him write
``I will not fold my hands while armed herdsman invade communities in Ekiti, killing people and destroying farmlands at will, like they did in other states.
``I have directed the police and other security agencies in the state to fish out the killer herdsmen’’,
The statement con still say
The governor don say eyah! give Oke-Ako people, especially the family of the once wen die, con swear say him go do everything wen him fit do to make sure say they lock does bad men for kirikiri and make sure say he no happen again.
Him stil say these herdsmen na big wahala and threat for Nigeria unity and the people wen dey inside him con still say him dey dey wella with security agencies.
Read wetin him talk
``The people of Oke-Ako should therefore remain calm while the security agents do their job,
``The security agents must, however, be mindful of the fact that the people’s patience has a limit and they must act promptly and decisively’’, him talk
Him con say farmlands wen reach billions of naira na him dey scatter like say tomorrow no dey for inside the state for the South-West, South-East and North-Central zones for inside the country.
ConversionConversion EmoticonEmoticon