Photos: Adams Oshiomole, Apostle Johnson Suleiman show face as Comedian I Go Die present the Mansion wey im build for im Mama.



Adams Oshiomole, Apostle Johnson Suleiman, Delta state Deputy speaker Rt. Hon.Friday Ossai and many mek sense people, join I Go Dye as im bless im mama with the The Royal Golden Eyes castle, wey im Build for her.


This na to honor im mama as dem celebrate Mother’s Day.

The comedian open the house, wey im company Revamp Construction build. And na wan French company do the sculptural work.


The mansion dey for Amb. Francis Agoda Boulevard inside Delta State. 

As he be, e get golden walls, 6 bedrooms and one cinema pavilion and many mek sense things.

The Golden Eyes Castle, still get one customized golden sculpture of im grandmama, Queen Agnes.





Previous
Next Post »

Featured Video