Yes o, the last 5 contestant still dey the house,
Efe,
Bisola,
T-Boss,
Marvis and
Debbie Rise, and everywhere just dey hot ontop this matter. na Efe matter hot pass sha
From every every wey we gather from T-boss fans, dem yarn some major reasons wey go mek Tboss win, nayim we say mek we share am for here.
Yes every body know Bobrisky, that guy wey won turn woman,
Ever since the BBnaija start, Bobrisky don show full support ontop T-boss matter, anytime she enter eviction.
The guy abi lady, don use im social influence take mek people vote for T-boss, Instagram, especially snap chat,n you know say bobrisky get plenty fans. sote the guy enter Unilag dey share recharge card, for say mek people vote for T-Boss.
Even before the last eviction dem see Unilag student, dey vote for Tboss.
Wan guy been come out for twitter dey claim say, im spend 200k to vote for T-Boss, If this guy fit spend 200k, T-Boss family fit spend millon for their pikin to win.
Una still know say Tboss get plenty enemy, cause of the ways she dey behave, and say she no fit sing National anthem, but that one no mean say, she go loss, abi you don forget say na she get the highest vote for the last eviction?
Na all this point T boss fans carry give us oo, no be our mouth you go for hear say, bicycle jam somebody die for okpetu market o!.
Godsgift Ajomafuwe is an handsome young smart passionate optimistic individual, a social media Manager, a content developer, Photographer, leader who has worked and voluntered for alot of organization.he belives our life is what we make of it.
Related Post
“My dogs eating better than some of y’all”. Davido brother Adewale Adeleke yarn.Singer Davido brother, Adewale Adeleke, don come out dey yarn say, im dog eat beta pass some o
Naija Army honour Comedian I Go Dye Nigerian Army honour comedian I Go Dye, as the chief of Army staff wey be General TY Buratai give a
Wetin you think say "N'abania" Flavour dey yarn with im two pikin? , oya check out the picture."N'abania" Flavour, share picture of im self and im two fine pikin, Gabrielle and Sofia, for I
#bbnaija : Nigeria people seriously bash T-Boss sister after she yarnn say, Naija people na racist.Wendy, wey be Tboss sister, enter Instagram,, con yarn say, dem suffer from racism, wey be "i know
ConversionConversion EmoticonEmoticon