You don tire for your present love relationship? Oya check out the simple ways to end am.



No be watin you end be the koko, na how you take end am nayim matter.


Image result wey dey for breaking up with your girlfriend

Breakup na one bad experience, wey you no won get, and we believe say, you no like make another person experience am.

Some people don tire for their relationship, as the love matter, no get head again, and dem go like to end the relationship. But the thing be say, dem no know how to end am.

See eh, if you won end this kind relationship, you fit use gragra end am, or you jejely end the relationship.

For the jeje breakup, you fit dey show you boo or bea, small small sign, wey go make am see say, you no won do again, or you fit kukuma ask person, to help you tell am.

But sha know say, if person help you tell am, yawa fit gas from your bea or boo side, as e go pain them wella.

Breakup fit go from bad to baddest, but he depend on the pattern, wey you use take end the love matter.


1) We don confirm say, the correct way to take end love matter, wey be relationship, na to face your boo or bea, korokoro, and yarn all the plenty plenty thing, wey dey your mind,  and the reasons, wey mek you no wan do again

2) Another way, na to blame yourself, as the reason why, you no wan stay or kontinu, for the love matta again.                                                                                     
You fit put am like, bea, boo "No be you be the cause of this break up, na me" you go see say the love issue go end well small, as you no go give the main reason why you won end the love matta, but you know say na your bea or boo fault,  you won just do am like that, so you bea or boo,no go feel bad

3) You fit still use style, take dey commot small small from the love matta.                                
You fit dey delay the breakup, dey wait for the main time, way you go drop the bomb, or you fit dey use one eye, dey look if your bea, or boo go change im ways                                                                                                                                          
4) Dey try hide from your bea, or boo. but to dey hide, nayim bad pass, as you go dey give excuse everyday, like why una no fit meet.  You no go won help again for the things wey concern the relationship. you no go even won show love to your bea or boo again. 

5) As e dey hot, you fit still just dey, dey fine fight or trouble, you fit no dey gree for any matta with your bea or boo, you fit still dey ask for many many things, until your bea or boo vex say dem no do again.

6) You fit still use indirect way, take talk say, the love matter don tire you, like you fit put another person photo for your dp, or may you dey call another person sweet names, like honey, dear or my heart, you go see say, your bea or boo, go get the gist sharp sharp.

7) Oya I go stop with this one. You fit mek calls be problem, as you no go dey pick im call, or even call back, when you see your bea or boo miss call, or you fit write the breakup note, send am give am for im email, or Facebook.

E go better if you end your love matta, with the face to face pattern, as na im make sense pass,

Research don show say, people dey use different pattern, take end their relationship, depending on the way their boo or bea be, or the way them feel like to take end the love matta.

But sha know say, all the pattern get, good and bad side, so shine your eye choose one correct pattern.

Previous
Next Post »

Featured Video