Food & Fitness Expert Kevin Curry go show face for GTBank Food and Drink Fair, no miss am!



Kevin Curry sef go show face for the The GTBank Food and Drink Fair, wey go shelle for on April 30 and May 1, 2017


Kevin Curry, na food and fitness expert, im be alumni of Harvard University, na dnayim found  “FitMenCook”

As he be, “FitMenCook”, na one ogbonge online, site, wey dey promote the betaness ontop fitness and to mek sure you get the correct gbam gbam ways to cook beta food, as im get plenty people wey dey wakajugbo follow am, for online.

Kevin na person wey all im mind na to bring out the betaness of every every, wey concern food, and the food sweet sote, you go ask for more, like Oliver twist.

Plenty people don learn from this ogbonge man, and dem dey follow im foot step..

On May 1, 2017 for 4:15pm, Kevin teach for im Masterclass for the GTBank Food and Drink Fair, where i go yarn how im food take dey sweet and how im mek am reach this level.

Abeg know say this GTBank Food and Drink Fair na FREE, anybody fit come, no need for registration.

Ok na, you wan learn from Kevin ?Oya Click here- http://foodanddrink.gtbank.com/registration/masterclass/ mek you register for im Masterclass.

https://www.youtube.com/watch?v=AmsG9wcUJq4







Previous
Next Post »

Featured Video