#MCM: Check out Five things wey you need to learn from our Crush EldaDavid Kehinde Samuel.



And Our #MCM land ontop the Boss! Eldadavid Kehinde, and we dey crush ontop Elda like kilode.



Check out five things you really really need to learn from KwekeO Crush.

1. Smart Work.
          Yes, our crush na persin, wey no dey work hard, but im dey work smart, and dey produce mek sense result, wey people dey see, as im don use im smartness, impact and change people life.

Image may contain: 1 person, playing a sport and screen

2. Opportunity.
      Yes, our crush no dey use eye see opportunity, im dey use both nose, and ear plus eye take catch opportunity and im believe say opportunity dey everywhere, na for you to go jak am.

Image may contain: 1 person

3. Consistency.
      Any better thing wey our crush put hand, im must mek sure say, that thing finish. as im no go give up on till im get wetin im want.


4. Volunteer.
     Oya na, our  crush can Volunteer for Africa, and this don give am many opportunity, and ways to take change people life.

Image may contain: 1 person

5. Determination.
     Ok na, Our crush dey determine, anything im won do, no matter the wahala and things wey won block im way, the guy still dey move on, cause im believe say nothing, fit stop am.

Image may contain: 4 people, people smiling, people standing and beard

If you learn all this from our Crush, we believe say, you life go beta pass as he be.

Oya, See who our crush be below.

ELdaDavid Kehinde Samuel, na Non-Profit Specialist, Human Capital Development Professional, Technology Inclusiveness Advocate.
.
Elda graduate from the university of Benin, where im for get Bachelor’s of Science degree inside Banking and Finance.
Elda na Omò Eko.
.
Elda, nayim be the Program manager for Team7project-Youth Technology Development Center,
Executive director for MTC Foundation.
Executive Director, Murli .T. Chellarams Foundation
.
.
As he be, Elda don work and volunteer for plenty mek sense Organisation like, im be the Former Facilitator for Political and Economy Leadership Academy,
Former Associate Consultant for Releaf, Former Executive Team Lead for League of Young Professionals, Nigeria, Former Program Assistant for W.TEC - Women's Technology Empowerment Centre ,
Former Social Media Assistant for Patabah Books,
Former Human Resource Professional (Intern) for AGDC
.
Elda, na fellow of former Presido Barack Obama Young African Leaders Initiative (YALI Network Face2Face Group inside Lagos, Nigeria) Network. And im don use this Yali platform take impact life as every mouth im dey orgnaize event, where speakers nationwide, dey come yarn how betaness, go dey inside we country, and our life.

Image may contain: 2 people
Image may contain: one or more people


Previous
Next Post »

Featured Video