One man wey kill im four pikins, con force im wife, to see as dem dey die, nayim we hear say, court don sentenced to, 102 years inside prison.
Mr Gregory Green, 50, tell court say, yes o, na im kill im two children, wey dey four and five years, as im poison dem with carbon monoxide i.e smoke, con shoot im 17 and 19 old step pikins die.
This bad man, still cut the face of im ex wife, Faith Harris-Green, the mama of the four children, con shoot her for leg, before im tie her hand with rope.
Faith Harris-Green, finish her ex hubby, with curse for court. dey yarn say, the man nayim be devil imself, wey every body dey cast and bide.
Read wetin she yarn
"I can still feel the zip ties around my wrists. Some days I wish I died. There's a hole in my heart and soul that will never be repaired."
Green, 50, wey don been enter prison for 1991 sake of say im stap im ex wife wey carry belle to death, yarn say “Only God can judge me” Before dem sentenced am to 102 years.
ConversionConversion EmoticonEmoticon