One Big Bear nayim nearly use one man do afternoon food, after the guy wyn am with food, as the guy use play play, dey give the bear food.
As the matter be, Naiphum Promratee wey dey 36 years, and im paddy dem, waka go one temple inside Phetchabun area for Thailand, where im for go fine the bear trouble.
Im use rice take wyn the bear, before the big bear, gbag am enter im cage.
After dem fail many times to save am, one of the group run enter the cage, use beta pole beat the bear, while paddy dem save Naiphum.
Dem rush Naiphum enter hospital where im for dey take treatment.
ConversionConversion EmoticonEmoticon