Our #MCM Land ontop the samakwe crooner Mr Harry Song
The Ijew pikin wey come from Delta state, don work with plenty artist inside Naija and don even win plenty awards. Harry song been dey Five star music but now I'm don get im own label wey im call Alter plate.
For 2013 Harry Song do tribute song, to the late Nelson Mandela, and that song eh mek sense die, sote MTN carry am for head. Approko enter town say, Harry song make 50 million from the song via MTN callertune.
Uptill today Harry song still dey burst our brain wit make sense gbedu
Check out 5 things you need to know about Samakwe singer
After Harry Song start im career, for street, where im for mek name, na there Nollywood Actor, Richard Mofe Damijo (RMD), for advice am say, mek im park enter Lagos, so im go sell wella, for everywhere inside Naija and obodo.
2. Harry Song been sleep under Ikeja Bridge.
One day, when Harry song go perform for club, im come back late, and dem don close gate, so im decide to sleep under bride for Ikeja, till day break.
3. Im been dey perform for club before im meet Kcee.
Harry Song enter Lagos, from PH for 2007, where im for perform for night club, na there, im for see Kcee, wey God use bless am.
4. Harry Song Na Music Director
The guy still get many talent, as im self fit play plenty music instrument and fit direct videos, im been dey direct, before im chuck all im hand, inside musical production and performance.
5. Harry Song Sabi Play Five Musical Instrument.
The guy get beta voice, im sabi play drums, piano, flute, and bass with acoustic guitars. the guy Good!.
ConversionConversion EmoticonEmoticon