Apostle Johnson Suleiman side chick don expose their secret love life.



One Canadian based Nigerian, wey name na, Stephanie Otobo don accuse the founder of the Auchi-based Omega Fire Ministries, Apostle Johnson Suleiman, say dem get secret affair.

woman who accused Apostle Suleman arrested

She say, Apostle Suleiman dump her, after im promise her marriage.

Stephanie Otobo, wey be Ontario based musician, still yarn say, the preacher dey use the Nigerian police, dey silence her, and say dem don keep her, for the Federal Criminal Investigations Department (FCID), Alagbon.

Stephanie lawyer yarn say, Apostle Suleiman and Stephanie, meet for September 2016, when she visit Nigeria from Canada, where she for base.

So, dem start lovy lovy relationship, and Apostle Suleiman, tell her say, im don divorce im wife, and say im went more male pikins.

She say Suleiman, yarn say im won marry Miss Otobo, and she agree.
After she get belle for Apostle, Apostle say, mek she delete the belle, con give her concoction wey mek her bleed like say, na tap dey rush.

 Otobo yarn say, Apostle run leave her, say im no marry her again.

Stephanie Otobo

Stephanie Otobo, through her lawyers, dey ask for just N500million as damages for say im run leave her, and no marry her.

She still warn say, she go release naked pictures , text messages, bank statements, and other things wey go implicate the preacher, if im continue dey deny am.

Previous
Next Post »

Featured Video