Otobo comout on monday, as she claim say Apostle Suleman, give her belle con run.
As he be, this matter still dey cause yarn for social media, as she yarn say dem get secret lovy lovy relationship.
Sote Otobo carry Nigerian top law chamber, Festus Keyamo chambers to come help her chuck eye for the matter, as she won carry Suleman, enter court.
Apostle Suleman, don say na lie o, say this girl dey lie for im head.
Suleman yarn say, im never see the girl face to face before,even though dem don been yarn, about her problem for 2016.
Read also: Apostle Johnson Suleiman side chick don expose their secret love life.
Police arrest Otobo, as dem claim say, she dey blackmail Suleman, to collect N500 million from am.
Dem say she dey wait for court to yarn ontop her arrest
The papa of the girl, don yarn say, nothing shelle between in pikin and Apostle, say im no believe say im daughter fit spoil this man of God reputation.
Photo credit LIb
ConversionConversion EmoticonEmoticon