Fulani HerdsMen Gbege Demsa community for Adamawa kill 30 people



Fulani herdsmen enter Kodomun community for Demsa local Government inside Adamawa kill 30 people.



As the matter be, dey gbege the community kill 30 people, scatter people house for the area kill children and elderly people wey leg no fit carry waka.

Mr Hyniel Giwa wey be the head of the Hunters and vigilante group for the area say this gbege start since on sunday till on monday morning. 
im say assuming no be the security force dem and the vegilante, dey for don burn Kodomum Village reach ground. im say as dem hear the sirens of the brigade commander and the commissioner for police wey dey enter the village, na that time dey carry dem self run from the community.

Giwa still say some of the villagers don run comot from the community wey Fulani gbege. im say some dey run go Yola wey be the state capital, the once wey injure dey hospital for yola, dey don bury the once wey die for on wednesday.

But the superintendent Abubakar Othman wey be the spoke man for  the Police state command, say 11 people die for the gbege and many injure wella.

 Hon. Barr Kwamoti Laori enter the community yesterday, dey do eyah. im carry food follow body.





Previous
Next Post »

Featured Video