Leave Buhari Certificate alone O!,or we go sue you; Garba shehu



The presidency on sunday, don dey shout kweke ontop the head of one lawyer wey name na Nnamdi Nwokocha.
The reason for the shouting be say him too dey chuk mouth ontop presido buhari certificate matter as the case dey for court dey wait.

Na the senior officer for presido ontop media publicity matter Garba shehu out kweke ontop this matter give journalist for Abuja.

Shuhu don dey drow ear give that lawyer saw if him no stop the nonsense wey him dey do say the presidency lawyer go sue am

Him say news papers no be court wey person go comout con dey say somebody dey guilty wey court never say the person dey guilty...

Him still say even if him get freedom of speech that one no mean say him go dey talk anyhow, say the lawyer na PDP member and na this way him won take get power back, sake of say dey win dem for last election.

Previous
Next Post »

Featured Video