Eh eh the gbege wey shele for owo town ehh, for inside ondo state, mouth no fit talkam finish.
Cause of this gbege all the things wey be say the student plan to do dey no fit doam again. cause of the gbege wey shele..and this one shele for Rufus Giwa polytechnic for owo, and the gbege happon between Student and Police and blood just dey floor like water..
Dey say plenty people injure for this gbege,some break leg,head,nose eye even yash for this one and moto wey nothing concern nayim dey scatter ontop this gbege.
hmm dey even say police kill one of the student
Dey Say this gbege shele wey police patrol van jam some student, the police man con tear race instead mekhim carry dem go hospital.
Nayim Student con para, sote dey carry dem self enter Division B police station for Otapete area inside the town..
The gbege con still pass gbege, wey the police con spray tear gas ontop the student wyn eye dey red....
Na this one con mek student con para dey scatter moto sote police kill one student'
Mr femi Joseph wey be the state police public relation say the student cause plenty wahala say na the student attack dem.
him con still say the student injure the police officers dem wey dey duty con still injure the DPO for the Division B sotee him land for hospital
He never finish o,,him say all wetin the student talk na lie, say the officer no know befor him jam the student and him still carry the student go hospital.
Mr Timileyin Ayenuro wey be the Vice presido for the National Association for Nigeria student say mek dey comot the Division police officer from office sharpaly sharpaly and mekdey realise the student wey police arrest.
ConversionConversion EmoticonEmoticon