Naija artist need money pass award as dey turn up for Rhythm Unpluggd and turn down for the Headies award.



 Many of the big artist no show face for The Headies award, but show face for Rhythm Unplugged
 Dear Rhythm Unplugged, we can't take it: This is too much excitement for one night!

Eh The Headies 2016, na wetin people go talk till this year end. as we no con even know wetin dey happon, to some of our artist.

This Rhythm Unpluggd shele for the same venue as the Headies, the next day.

We see, top artists wey no come the Headies, but show face for Rhythm Unpluggd. top artist like Olamide, wey win two award, Adekunle Gold, Reekado Banks, Korede Bello, Tiwa Savage, Waje, Omawumi, Davido, Tekno, P-Sqaure and many others wey be say dem nominate for the
Headies, show face for Rhythm Unpluggd but no show face for the the Headies

We no dey surprise, say Tekno no come The Headies award night, as im be get small wahala with the Headies management.

Don Jazzy and Korede Bello on their way to Abidjan on Thursday

Don jazzy, Tiwa Savage and Korede Bello, enter Cote D’Ivoire capital city, Abidjan for one show for the same night as the Headies.

But for some artists and fans Headies na one of the biggest award platform inside Nigeria and dem no go one miss am for anything.
Rhythm Unplugged
But now, the artist for Naija don show us say, na money very important pass award. as Olamide go talk, Who Headies epp?

Rhythm Unplugged go happy wella as all the big artist show face. this na the 12th edition of Rhythm Unplugged and top  artist give better performance ontop stage.

Previous
Next Post »

Featured Video