Na wa o, See the Female Pastor wey dey sell Children inside her Church.



Peace Udoh wey be pastor of Divine Yard Ministry for Iyana Iyesi, Ita, Ogun state, nayim we hear say police arrest, for say she dey run baby factory for inside her church.



As the matter be, Punch Metro yan say, the 47 years old woman don sell like 64 babies, before the Lagos State Police Command finally catch her for on Sunday.

Police catch her with one nurse wey name na Mrs Bukola Ajala, na she dey assist for child birth for Udoh church, and one Angela Akpan.

Punch Metro still yan say the pastor, dey carry women wey their case dey serious, give this nurse Bukola Ajala wey her clinic name na El shaddai Hospital.

We hear say Angela sister, Goodnews wey dey seventeen years old, carry belle and na for the clinic she for born.

Angela, wey dem arrest for on Saturday inside Sango area, carry police on Sunday, waka enter Udoh church and Ajala clinic, where dem for arrest dem.

When dem dey parade this women, for the Lagos state command headquarters, inside Ikeja, the commissioner of Police, wey name na Fatai Owoseni, yan say police arrest the women, when approko enter their ear say Udoh need person, wey go buy Goodnews pikin.

Read wetin the CP talk
“The suspects run a baby factory in the Sango Ota area. We are still working to get 64 other children she has sold out,” The CP talk
Read wetin the Pastor talk.
 “I have been a pastor for 13 years. I only assisted my church members during childbirth. I take delivery of 13 to 15 babies every year and I have handled over 60 cases so far. I don’t sell the babies.“Whenever I have a complicated case, I refer the patient to the nurse and we share the money she collects for the service. Angela brought her sister to me in July. She gave birth on November 16 at the nurse’s clinic and she was discharged. I was surprised when the police came to arrest me yesterday (Sunday).

Read wetin Angela talk.
“I am from Abak in Akwa Ibom. I took my sister from our village to the pastor when her pregnancy was four months. She was there until she gave birth in November and I paid N17,000. I didn’t intend to sell her child and I have never sold any child before.”

Read wetin Goodnews wey carry the belle talk.

“I got pregnant in the school but none of my boyfriends was willing to take the responsibility for the pregnancy.“My mother would not allow me stay with her so I decided to follow my sister to Lagos,”


Previous
Next Post »

Featured Video