Mek Una chill we never mek final decision to sell Naija Assets; Minister of Budget tell Critics



Udoma Udo Udoma wey be Minister of Budget and National Planning say FG never won sell Naija assets.


 

Im talk this one for on Tuesday, September 27 when im dey talk for the  57th Annual Conference for the Nigerian Economic Society inside Abuja.

Daily trust  talk say Udoma Yarn say, mek all those people wey dey criticize dem chill first, dey never make final decision ontop the sell sell things. 

Udoma say the plan na just proposal,  wey FG bring and dey never make any final decision on top the matter. Udoma talk for one statement wey in Media Adviser, James Akpandem release for on Saturday September 24  say Government no dey plan to sell all Naija property. 

Sanate don before yarn say dey no agree to sell Naija property.  




Previous
Next Post »

Featured Video