Police Arrest won Prophet wey dey tochlight 13yrs old boy for Anambra



 Anambra Broadcasting Service carry this tory comout say Anambra Police Command Arrest won Prophet sack of say im Rape 13 years old boy. Na wa o nothing wey persin no go see.



This one happpon for Anambra, as police arrest this prophet wey name na Prophet Ekene Adoji for say im dey do touch lighting ontop 13 years old boy.

According to Wetin we hear this prophet, don dey run since August, 19th, 2016. until God con catcham, as people gbegeam enter the booth of im moto, enter church, con carryam give police.

Mrs Nkiru Nwode wey be the police Public Relations officer say two medical report wey dem do, show say dey really really tochlight the boy.
Mrs Nikiru still say make people dey open Eye and Nose plus Mouth for anywhere wey dem waka enter, she still dey draw ear give mama and papa dem, say mek dem dey put eye ontop their pikin.

Prophet say na lie oo, im no touchlight the boy wey name na Abuchi but say, the boy dey the church the time wey he happon.
PPRO don comout dey say dey still dey do investigation ontop the matter, say dey go soon carry this prophet enter court. 







Previous
Next Post »

Featured Video