Mek una get better evidence befor una spoil my ministers name: Presido Buhari



Presido Buhari dey say abeg mek una talk well o, mek una no talk wetin una no know. 


President Buhari don comout dey say mek naija forget all those badmouth wey people dey talk about im ministers, as dey won spoil the name of the im ministers and im senior officers dem, say im government dey corrupt.

Im still say people just dey talk anyhow say dey no get any better evidence.

   Im shout kweke ontop this matter, wen im hear say the immediate past Group Managing Director for the Nigerian National Petroleum Corporation (NNPC), wey still be the Minister of State for Petroleum, Dr Ibe Kachikwu, as dem talk say dem dey  investigatam for say im swap crude oil deals and con still lift gas,  the time wey im been be the GMD for the petroleum corporation.

Presido Buhari dey say abeg mek una talk well o, mek una no talk wetin una no know.

Read wetin im talk

"Terrible and unfounded comments about other people's integrity are not good. We are not going to spare anybody who soils his hands, but people should please wait till such individuals are indicted,"


Previous
Next Post »

Featured Video