Banky W Chuck mouth inside Davido and Wizkid beef, after Tekno wave enter for Twitter.



Banky W don chuck mouth inside Davido, Wizkid and Tekno fight, this time na to quench every badmouth, wey dey fly for their social handle.


As the matter be, Tekno Chuck mouth for the fight after Davido slam wizkid for the new dong wey Olamide feature am "Summer body" based on say wizkid been callam local champion.

Tekno con chuck im mouth for twitter ontop the matter say “Na just time, soon we go know who international pass” still say may Wizkid, go for HIV Test.

Na so Starboy, give Tekno beta reply for Twitter, call Tekno Duck lolxz : “Good morning, Ducks don’t play where lions play! Enjoy your day my people!”


Tekno no tire o, im give wizzy subste reply : “Lions are animals! and humans don’t fight… be your brothers keeper! RARA O #allloveonthisside.”


As the matter dey go, people don slam Tekno ontop, why im go Chuck mouth inside the beef wey no concern am?.

But Banky W, wey dey see all this drama, don put mouth. The EME boss, shapaly shapaly enter instagram, con call the artiste say, may dem work together, as im use Jaz Z campaign for black take give beta advice.

Read wetin im  yarn below.

“What’s better than one billionaire? Two” What’s better than one of our Artists conquering the world? Two? Three? 10?? All?? Wish we would all just quit the mud slinging and get back to pushing the movement forward. When you’re running a race, if you stop to throw stones at every dog that barks, you’ll never reach your destination OR you’ll get there much later than you should. And.. a mud fight may seem like fun, but in the end, everyone just comes out looking like shit. Food for thought. #TheBankStatements Nobody wins when the #FamilyFeuds

Previous
Next Post »

Featured Video