Woman wey troway her one day old pikin for suckaway, yarn say na hungry and sufferness, nayim mek her troway her pikin.



The mama of 6 children, yarn say, the suffer don do much, nayim mek her troway her pikin.


Bauchi State Police Command don arrest one Juliana James, wey come from Shendan Local Government Area for Plateau State, inside one village for Bauchi, for say she troway her one day old pikin, inside soakaway.

The mama of 6, yarn give journalist, as police dey carry her patrol, say na sufferness, hungry, and hardship, nayim mek her throway the pikin so.

Read wetin she yarn

“Things are hard. My husband has no job. He had an accident three months ago. He is still in the hospital  and the situation became worse for us. We don’t see food to eat. We were dying of starvation. I delivered at home and threw the baby into the toilet because I didn’t know how we are going to take care of it. I didn’t tell my husband,”

She yarn say, as  she no fit bear am, dey hear as the pikin dey cry from the sockaway, nayim she call neighbors dem, to come help her, after she tell dem say, she troway the pikin

Dem save the pikin, nayim dey rush the pikin enter Abubakar Tafawa Balewa University Teaching Hospital, where dem for dey treat her.

Previous
Next Post »

Featured Video