One Ogun state House of Representatives member, wey name na Segun Adekoya, don cry say mek dem ban Big Brother Naija from Naija.
Segun Adekoye, wey be Ogun senator, don yarn say, BBNaija na nonsense, mek dem ban am.
Sake of say, dem dey do, touchlighting things, inside Naija TV. As na Kissing, sucking and fingering and people, wey won be ashawo, nayim full inside Big Brother Naija.
Adekoya, carry the motion enter the House, but no dey, the day, wey dem won yarn, and debate ontop the motion, for on Wednesday, March 1.
So dem no yarn ontop the motion again, sake of say, Adekoya, no come the house that day, but that one no mean say, dem no go chuck eyes inside the motion again.
Read wetin Adekoya yarn according to Premium Times.
‘By virtue of the existing laws, broadcasting in the country is expected to promote Indigenous cultures, morals and community life and not to encourage values of the country.’
‘We must tell ourselves the truth. The show does not promote good ethical or cultural values. It does not amount to any economic gain for Nigeria.
‘Let them continue it in South Africa where homosexuals are legally allowed to get married. But in Nigeria, we still stand by our strong moral and religious ethics.’
As he be, Big Brother Naija, start for January 23 and go last for 90 days, until mid April where the last housemate go win, and carry N25m cash prize.
ConversionConversion EmoticonEmoticon