Five years old girl Aliyah Masaku wey her land lord three dogs bite for inside Ikorodu anyhow, don die.
Yesterday, we yarn about one 5 years old girl wey landlord, three big dogs bite anyhow. Today, tori don come out say the small girl don die.
Her family people, yarn say she die yesterday evening, after she don suffer many pains, due to the injuries, wey the dogs put for her body.
Read also:
LandLord 3 big Dogs, attack tenant 5 years old pikin, chop her anyhow.
As the tori be, on Monday, the Land lord dogs, escape from their cage, con gbege the small girl, as dem never give dem food, for weeks now.
Dem say one of the Dogs wey name na Rover, attack the small girl, con drag her enter the back of the house, where the other two other dogs, for join chop her.
We don hear say, the youth for the area, don join hand kill Rover.
Godsgift Ajomafuwe is an handsome young smart passionate optimistic individual, a social media Manager, a content developer, Photographer, leader who has worked and voluntered for alot of organization.he belives our life is what we make of it.
Related Post
Barbed wire kill thief as im try to jump fence inside Kogi state.Everyday for the thief, one day for the owner, na there God for catch this one.
One thief Die a
"Presido Buhari go enter Naija before June 11" ex Abia Governor Izor Kalu yarn.Ex-Abia State Governor, wey be Orji Uzor Kalu, on Sunday, don yarn say Presido Buhari health don de
“I Am NOT your Role Model. I am just a 25 year old" Burna Boy tell fans wey claim am as role modelBurna Boy don react to some fans wey dey claim say, im be their role model, but the Dance hall Sing
EFCC don give us reason why their former twitter handler end im job.Olufemi Olukayode Adeyemi, wey we know as FShaw KingFisher, for social media, nayim be the guy
ConversionConversion EmoticonEmoticon