“Oh lord, break the front teeth of my enemies so that by their smile I shall know them". Apostle Johnson Suleman yarn.



Apostle Johnson Suleiman, don come again o,  this time, the Apostle don ask God, to break the front teeth of im enemy.

Break the front teeth of my enemies - Apostle Suleman

Some weeks ago, Department of State Services (DSS) try to arrest Apostle Johnson Suleman wey be founder of  Omega Fire Ministries, sake of say im tell im members to cut off the head of any Fulani person wey dem see.

Read also:  Fayose stop DSS as dey plan to arrest Pastor Johnson Suleiman after im tell church members to kill Fulani men.

when im dey react, to the recent kill kill, wey shelle for Kaduna, the Man of God yarn say, wetin christian do, wey mek dem dey kill dem anyhow.

For one tweets, the Man of God write say may God break the front teeth of im enemy, so im go quick know dem through their smile.

Read wetin im yarn below.

“Oh lord, break the front teeth of my enemies so that by their smile I shall know them.

“What have Christians done?. Why did merciless killings?. Why can't we all live in peace no matter our religious differences?..it's not right.”



Previous
Next Post »

Featured Video