#KwekeQuotes "Because say person start before you, no mean say dem go do better pass you, if na so, Nokia and Blackberry for get grade pass Apple." Sijibomi Ogundele.



"Because say person start before you, no mean say dem go do better pass you, if na so, Nokia and Blackberry for get grade pass Apple." Sijibomi Ogundele.


No wonder, dem say all fingers are not equal. Your present situation no mean say, life don finish. He go shock you say, chukwudi, wey know book pass for class, dey kiri pure water, and you wey teacher dey flog for say you no  know, dey drive car.

Because say im don mekam, no mean say you no go mek your own, every body blessing dey road dey come, your own fit pass the guy, wey dey show imself.

Because say im don go far, no mean say, you no go meet up, check the tortoise and Rabbit tory.

Wetin you need to do, na to continue to do, wetin you like to do, and put God join. 


Previous
Next Post »

Featured Video