AS he be, DMW Singer, Mayorkun, don do something wey mek everi body dey talk for social media, after im yarn say im rent full Cinema inside Owerri to watch “Banana Island Ghost”.
Mayorkun fans dem, don dey para say why the singer go waka go rent full cinema only im one inside, wey im suppose invite some fans come followam watch.
Still ontop the matter, the movie, don sell wella for the first week for inside Lasgidi cinema, and Naija don dey gather dey show their support as dem dey go watch am.
Read wetin Mayorkun post for im instagram:
“Mama Life’, Rented out the whole cinema just to watch ‘Banana Island Ghost’ 😂😂😂 Loool its such a great movie! @theonlychigul #BananaIslandGhost”
ConversionConversion EmoticonEmoticon