Michael Jackson daughter, Paris don yan about her papa death for 2009 and how she suffer..



Michael Jackson second child and only daughter, wey name na Paris don yan about her papa death for 2009.


According to paris, she yan say, dem kill her papa, she yan this one for one rolling stone magazine interview, wey dem interview her.

She dey 11 years old wen her papa Micheal Jackson die. Read the full interview HERE

After the death of her papa, she don dey depress, sote dem give her one anti depressing medicine, wey dey give her papa.
She still yan say, she try to kill herself many times.

 ‘It was just self-hatred… low self-esteem, thinking that I couldn’t do anything right, not thinking I was worthy of living anymore,’ 

when she dey talk about her papa death, she yan say, she remember when her papa MJ, dey say some people, won gbege am, say dem set up her papa.

‘He would drop hints about people being out to get him, ‘And at some point he was like, ‘They’re gonna kill me one day’. ‘It sounds like a total conspiracy theory and it sounds like bullshit, but all real fans and everybody in the family knows it. It was a setup. It was bullshit.’

She still dey say, when she dey 14 years, one old man, dey touchlight her, but she no gree talk the person name.

‘ I was crazy. I was actually crazy. I was going through a lot of, like, teen angst. And I was also dealing with my depression and my anxiety without any help’.

Paris Jackson at a 2011 Michael Jackson tribute concert.



Previous
Next Post »

Featured Video