EFCC don release former spokespersin to ex- presido Reuben Abati wey dem been detain



The Economic and Financial Crimes Commission EFCC don finally release Reuben Abati wey be former spokesperson to ex- president Goodluck Jonathan.


Reuben Abati carry imself enter EFCC office for on the 21 Oct, after im receive one invitation from the agency, say mek im explain im own part of the fraud wey im carry out with im people.
That day, that day nayim EFCC detain Reuben after.

Now Abati don agree say im go return N5million out of the N50million wey be say im receive from the former national security adviser.
we hear say im pay back the money after im don spend some days inside EFCC house.

We con still hear say EFCC seize im passport before dey release am.

Previous
Next Post »

Featured Video