Njideka Agwu, a major and still be the Assistant Director, Army Public Relations Officer (APRO), confirme the gbege give journalists for inside Minna, him say NSCDC don mek peace for the area. She con still say 24-year-old market man wen based for Padongari, wen name na Methodus Emmanuel say dey kill am cause of this grammar wen him do wen dey call blasphemy.
She say "Three other persons, even the personnel for Nigeria Security and Civil Defence Corps die for there. Troops of the 31 Artillery Brigade of One Division, Nigeria Army, run fast go mek sure say dey maintain law soteee army do watchnight for the area.
Ms. Agwu con still dey burn one religious house, one house and one shop and dey thife plenty things from 25 shops as the gbege dey go. She still say the bad boys dey stil go do onoda gbege on Monday morning, thife for inside people shops con still block the Lagos – Kaduna road.
The spokespersin say army don arrest some suspects and dey don carry dem give police. Him still say army don enter every rat hole for the area so that gbege like this no go happon again.
Read wetin Ms. Agwu talk
"As part of measures to de-escalate tension and ensure lasting peace in the town, the military is working with the local government council authorities and community leaders, including the Kagara Emirate Council, to pacify all aggrieved parties and build on the peace so far established,"’.
Ms. Agwu still say as the army dey make sure say peace dey, say anybody wen go won cause gbege go see something.
Source: Premium Times
ConversionConversion EmoticonEmoticon