Our beloved Crush today na
Korede Bello. After 3 years with mavin records
Korede Bello release mek sense debut album "Beloved", with mek sense producers wey chuck hand inside.
We believe say,
Korede go carry Grammy come house, cause all im song na hit!!!.
Like this we dey listen to all the mek sense gbedu, wey Korede sing for im album!. We dey crush on this guy die!!!
We say mek we yarn una 8 things wey we think say you no know about Korede Bello.
1. Korede Bello na one of the youngest singer inside Naija.
2. Korede Bello start to sing wen im dey 5 years, that year dem dey call am African Prince.
3. Korede Bello write im first song, wen im dey primary school.
4. Im form im first music group, with im female friend wen im dey Primary 6.
5. Im do im first studio record wen im dey secondary school.
6. Im papa, nayim buyer im Guitar, con still pay for im first studio session.
7. im maneger Casmir Uwaegbute, nayim introduce Korode to Don jazzy, for, February, 28, 2014.
8. Im first music with Don Jazzy na African Princess.
Godsgift Ajomafuwe is an handsome young smart passionate optimistic individual, a social media Manager, a content developer, Photographer, leader who has worked and voluntered for alot of organization.he belives our life is what we make of it.
Related Post
#BBNaija See the reasons wey T-Boss fans yarn, ontop why T-Boss go win the #BBNiaja2017Yes o, the last 5 contestant still dey the house, Efe, Bisola, T-Boss, Marvis and Debbie Rise, and
OAP Daddy Freeze drag Bobrisky come out after Bob wear fake Rolex wristwatch.Bobrisky wey dey call imsef king of Snapchat, enter im Snapchat account yesterday, dey show off say
Photos: Actress Mercy Johnson give us sexy levels, as she make sense for New Photos.Nollywood actress Mercy Johson Okojie make sense for this new photos wey DipPhotos snap, and we don
Photos: lolz see the cloth wey South African Dancer, Skolopad slay enter The South African Music Awards. South African Music Award wey shelle on Saturday 27th May 2017, inside SunCity bring plenty s
ConversionConversion EmoticonEmoticon