"If 2Baba get 7 children from 3 different women, wetin concern that one with garri for market." CharlyBoy blast people wey dey badmouth 2baba



Area Fada, CharlyBoy, don come out, dey blast all the people wey dey badmouth 2Baba We no go gree waka, ontop the Federal Government.


CharlyBoy, share this mek sense yarn, for Instagram, dey say, if 2face get 7 children from 3 different women, wetin concern that one with garri for market.

Read also: Gov Fayose media person don react to people wey blast Fayose for say, im won support 2baba we no go gree waka on 6th Feb.

Im still yarn about, how people dey suffer dey smile, and some of those people nayim go carry their teeth, enter social media, dey yarn nonsense, as their ear, never understand say, poverty and wuruwuru, nayim sit down berekete, for inside Naija

 Abeg Read wetin im yarn below

I just tire when I read some useless tweets and updates about Tuface.
As a Fada, e no go nice if I just sidon make some guys dey f**kup, dey miss yarn because dem Mumu never Do.
Have we not suffered Enough?
Are we not Hungry Enough?
Has Corruption not crippled our People enough?
Has Political Criminality not damaged our Morality enough?
Wetin remain again, no be to enter street?
If some can’t see the sense in the march 2Baba is organizing why must they insist on exposing their ignorance on our social highway? If 2Baba like make e get 7 kids with 3 babymamas, what has that got to do with the price of garri in the market?
Has 2Baba not been actively involved in the demand for good governance before now? So why is it that he has ulterior motives now.
Anyhow, anywhere any day I go show, because Na our future we they fight for. Since last year me and some exceptional nigerian youths are also putting together The Mother of all rally’s to be held in Abuja. We must see the end of this nonsense.
Pikin wey say him mama no go rest, him too no go sleep. We they come, them go know how far. Am calling on all celebrities wey get mouth to speak out and fall out. Everybody wey dey fraustrated with this country must show, enough is enough.
#OurMumuDonDo.

Previous
Next Post »

Featured Video