Femi Anikulapo-Kuti, don come out dey shout say im no blast 2baba ontop we no go gree waka as approko enter social media.



Afrobeat musician Femi Anikulapo-Kuti don come out dey shout say, na lie o, im no  blast 2Baba or yarn say, im no go support 2baba We no go gree waka o.

Image result wey dey for femi anikulapo kuti

Approko been enter social media, say Fela Anikulapo-Kuti , first pikin, wey be, Femi Anikulapo-Kuti, blast 2face, ontop the we go gree waka,
But im enter Twitter today, to clear the approko.

Read alsoLagos state Commissioner Fatai Owoseni don yarn why im put ban ontop 2face we no gree waka ontop FG

Im yarn say, im no blast 2face at all.

Read wetin im yarn.

“Contrary to reports I DID NOT blast 2face. I saw a report pic below saying protest was kicking off @ d Shrine I said I was NOT INFORMED,” 
"B4 protest date was changed it was meant 2kick off d Shrine I said I was weary as y wud a protest b announced @ d Shrine wtout my knowledge."
"I mean I wasn't informed It sounds fishy to me Next I will hear the Shrine has been closed for disturbances".

"And I NEVER said 2face came to meet me. I said y Did he NOT meet or call me if protest was kicking off at the Shrine."
"No problem protest venue and date has changed."
.
"Thank u o 2face is a friend/family of the house I would never Blast him in public. Not my style."

As he be, 2baba enter im Instagarm today, con yarn say, the waka go start from National Stadium, Surulere for 8:0am and Abuja waka go start from 9:am for Unity Fountain.

Previous
Next Post »

Featured Video