Danfo Conductors inside Lagos, go start to wear Uniform, Badge and Name tag, as from March 2017.



Another development don enter lasgidi, as Lagos state Government, yarn say as from March 2017, all bus conductors, go dey wear uniform and name tag.

Image result wey dey for conductors inlagos

Mr. Israel Adeshola, wey be the National Presido, ontop Bus Conductors Association of Nigeria (BCAN), don come out, dey yarn say, as from march 2017, e go dey compulsory, for all conductors to wear uniform, name tag and badge..

The Lagos state Government, don already sign this new system, since on Monday.

Read also: Gov Ambode don yarn say Danfo moto, no go dey inside Lasgidi again, before the year end.

Dem yarn say, the reason why, dem won do this one, na because of the safety, of conductors, and the public.

Dem say, any conductor wey thief, or commit any crime, dem go use the badge, take easily locate am.

And this new style, go pursue those bad guys, wey dem dey call "One Chance", inside the state, as na only people, wey dem register, go get the uniform.

Previous
Next Post »

Featured Video