The whole Naija, don come after Gifty of Big Brother Naija show, after she say she no know Banky W and Falz.
Yesterday super star, Banky W, visit the housemates, where im for give dem better advice.
Now Gifty, wey been yarn say, she no know Falz, don come again, dey yarn say she no know Banky W.
like seriously!!!
Gifty na one housemate, wey every man for the house, go like get one kind small join body things with, but Naija people no gbadu her style, as dem think say, she too dey form.
Now, she yarn say, she no know Banky. as usual, Naija people enter twitter, blast nonsense commot from her head.
As if that one no reach, She yarn say, Banky W too dey proud, and say Banky, na fake.
Read their tweets below.
ConversionConversion EmoticonEmoticon