Today na Adekunle Gold Birthday, checkout 14 things wey you no know about Gold.



Today na Adekunle Gold Birthday, nayim we say, mek we yarn you some things wey you no know, about this guy, wey im song dey scatter my dada every day.


For 2015 dem nominate Adekunle Gold for the most promising Art of the year, for 2015 City people entertinment Awards.
Dem still nominate Gold for Best Alternative song category for the Headies 2015 for SADE.


As he be Adekunle get plenty telent, he also get somethings wey you no know about Gold.
Check dem below
  1. Adekunle Gold, full name na Adekunle Kosoko.
  2. Adekunle Gold, na the only boy pikin of im mama and papa, but im get three sister, one don die.
  3. Adekunle Gold, na prince for Kosoko royal house.
  4. Adekunle Gold, na legendary Nollywood actor Jide Kosoko nephew.
  5. Adekunle Gold, study Art and Design for Lagos state Polytechnic.
  6. Adekunle Gold, add Gold to im name, after im hear won ogbonge preaching for church.
  7. Adekunle Gold, been dey among won boys band, wen im just dey start music, dem call the band "Bridge".
  8. Adekunle Gold, na sculptor, painter and graphics designer.
  9. Adekunle Gold,  nayim Design YBNL logo, as im don get small paddy waka with dem, before im join.
  10. Adekunle Gold, be the number 3 most searched person for google inside 2015.
  11. Adekunle Gold, enter public eye wen im photoshop im self and one celebs. Dem con dey call am king of photoshop.
  12. Adekunle Gold, dey inside relationship with  singer Simi.
  13. Adekunle Gold, never reach 30 years, so mek una forget wetin im yan for "Sade".
  14. Adekunle Gold, 3 singles "sade" 'Orente" and "pick Up" na Simi mix and arrange dem.




Previous
Next Post »

Featured Video